魔鏡歌詞網
魔鏡歌詞網 > 歐美歌手 > Fela Kuti > Beasts of No Nation

Fela Kuti



歌詞
專輯列表
歌手介紹

Fela Kuti

Beasts of No Nation

Ah- Let's get now into another, underground spiritual game
Just go to help me the answer, go to say, 'Aiya-kata'- Oh ya

O'feshe-Lu
AIYA-KATA *(after each line)
O'feshe- g'Ba

O'feshe-Woh
AIYA-KATA *(after each line)
O'feshe-Weng
Aiya kata
Aiya Koto
Aiya Kiti
Aiya Kutu

O'feshe-Lu
AIYA-KATA *(after each line)
O'feshe- g'Ba

Oh-----...

Basket mouth wan start to leak again, oh-
BASKET MOUTH WAN OPEN MOUTH AGAIN, OH
Abi** you don forget I say I sing, ee-oh **(is it not)
BASKET MOUTH WAN OPEN MOUTH AGAIN, OH
Oh, I sing, I say, I go my mouth like basket, ee-oh, Malan Bia-gbe-re
(2x)

Basket mouth wan start to leak again, oh-
BASKET MOUTH WAN OPEN MOUTH AGAIN, OH

Fela, wetin you go sing about?
DEM GO WORRY ME... *(after each line)
(3x)

Dem go worry me, worry me-- worry, worry, worry, worry
DEM GO WORRY ME *(After each line)
Dey wan to make us sing about prison
Dem go worry me, worry me-- worry, worry all over da town
Dey wan to know about prison life
Dem go worry me, worry me-- worry, worry all over da town
*(repeat stanza)

Fela, wetin you go sing about?
DEM GO WORRY ME
Dem go worry me, worry me-- worry, worry, worry, worry

The time weh I dey, for prison, I call am 'inside world'
The time weh I dey outside prison, I call am 'outside world'
Na craze world, na be outside world

CRAZE** WORLD *(after each line) / **(crazy)
Na be outside- da police-i dey
更多更詳盡歌詞 在 ※ Mojim.com 魔鏡歌詞網
Na be outside- da soldier dey
Na be outside- da court dem dey
Na be outside- da magistrate dey
Na be outside- da judge dem dey
Na craze world be dat
Na be outside- Buhari dey
Na craze man be dat
Animal in craze-man skin-i
Na craze world be dat
Na be outside- Idia-gbon dey
Na craze man be dat- oh
Animal in craze-man skin-i
Na craze world be dat
Na be outside- dem find me guilty
Na be outside- dem jail me five years
------------------I no do nothing
Na be outside-dem judge dey beg ee-o
Na craze world be dat, Na craze world be dat
Na be outside- dem kill dem students
Soweto, Zaria, and Ife
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat,
Na be outside- all dis dey happen
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat, ee-oh...


Make you hear this one
War against indiscipline, ee-oh

Na Nigerian government, ee-oh
Dem dey talk ee-oh
'My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline'

Na Nigerian government, ee-oh
Dem dey talk be dat
'My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline'

I never hear dat before- oh
Make Government talk, ee-oh
'My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline'

Na Nigerian government, ee-oh
Dem dey talk be dat
Which kind talk be dat- oh?
Craze talk be dat ee-oh
Na animal talk be dat